By: Esther Ayoola
Trial for five people wey bi suspect for di June 5, 2022 terror attack wey sup for St. Francis Catholic Church, Owo, Ondo State, don start again on, on Thursday for Federal High Court, Abuja.
One Catholic priest, wey court call “SSA” for security reason, testify from behind screen, talk how di attackers waka enter church, kill over 40 worshippers and injure more than 100 people.
Di suspects na Idris Omeiza, Al Qasim Idris, Jamiu Abdulmalik, Abdulhaleem Idris, and Momoh Abubakar.
DSS dey prosecute dem for nine counts of terrorism.
Di priest give him evidence under cross-examination by DSS lawyer, Ayodeji Adedipe, explain wetin happen step by step and how di attack affect plenty people