By: Rilwan Agbomeji
Vice President Kashim Shettima don buy waka visit people wey wunjor for di bomb wey happen for Gamboru Market Mosque for Maiduguri, Borno State.
Im go see dem wey dey hospital and carry sympathy message from Presido, Bola Tinubu and Federal Government begin share, share give dem.
Shettima talk say government go still dey support di victims and dia families.
According to security official report say at least five people die, while 35 others dem injury during di evening Maghrib prayer.