Lagos

Overspeeding Motor Kill 9-Year-Old Pikin, Injure Four For Lekki

todayDecember 29, 2025 4

Background
share close

By: Esther Ayoola

Unto matters for Lekki area, say one unkown driver go jam  five pikins  with im koropke, kabu kabu motor for Lekki, Lagos, afta im motor lose control.

According to report, say di driver bin dey drive wawa speed, jam di innocent children wey dey dia own, Igboa.

From statement wey fall out from di area Controller General of di Lagos State Fire and Rescue Service, Margaret Adeseye, di accident happen about 2:31pm for Wole Olateju Crescent, Lekki Phase One.

Adeseye say, di Four pikin between eight and thirteen years get serious injury and dem don  carry dem go hospital, while one nine-year-old boy kpai on di spot.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app