By: Esther Ayoola
Di honourable minister of di Federal Capital Territory don bring out im weapons of mouth destruction sama governor Seyi Makinde of Oyo state wetin nor good, say im lie for national TV
Wike drop all di lines wey im fit drop for TV sitdon tuk with tori pipo on Monday, say, im nor promise president Tinubu say im go hold di Pipos Democratic Party down for am to win 2027
E say, dat can mata dey since why Makinde wait dis long before im comout dey yan okpata.