By: Rilwan Agbomeji
Wi oga Presido, Bola Tinubu don to cancel big part of debt wey Nigerian National Petroleum Company (NNPC) dey owe Federation Account.
Dis na according to Nigerian Upstream Petroleum Regulatory Commission talk for report wey dem present at November 18, 2025, Federation Account Allocation Committee (FAAC) meeting.
Di report show say the cancellation go wipe about $1.42 billion and N5.57 trillion afta both NNPC and Federation Account reconcile dia records.
Di approval come as part of effort to correct outstanding obligations and streamline revenue management between NNPC and di Federation Account.