By: Rilwan Agbomeji
Iran don finally respond to Donald Trump say dem go give am hot, hot, back to sender, if America or anybody try attack dem again.
Dis one come afta US presido Donald Trump threaten say America fit strike Iran if dem try rebuild nuclear or missile programme.
Iran presido Masoud Pezeshkian clear tori pipo for office, say any aggression go bring serious regret, as Iran no gree negotiate missile marras.
Di talk don raise fear of anoda war, just few months afta di last fight wey kill over 1,100 people for Iran and 28 for Israel.