By: Esther Ayoola
Area spoil say Lagos State Government don cancel di 2025 Greater Lagos Fiesta wey suppose hold today, December 31, 2025.
Governor Babajide Sanwo-Olu, through im media aide Gboyega Akosile, ask make instead of di fiesta, Lagos people spend di time for personal prayers for Nigeria, Lagos State and everybody wey dey live for di state.
Di governor urge residents make dem pray for peace, good leadership, prosperity, productivity and general wellbeing.
Im wish all Lagosians happy and better 2026, say im government go work harder to bring better life for di people and encourage peace and unity.