National

NNPCL Show Report Card Of ₦502bn Profit For November

todayDecember 31, 2025 8

Background
share close

By: Rilwan Agbomeji

Di Nigerian National Petroleum Company Limited, NNPCL, say dem ma make ₦502 billion profit afta tax for November 2025, even though crude oil production drop small for di month.

Figures from NNPCL Monthly Financial and Operations Report show say di company generate ₦4.36 trillion revenue, as beta gas output, full pipeline operation and steady fuel supply help balance di challenges for upstream production.

Di report say crude oil and condensate production average 1.36 million barrels per day for November, wey be small improvement from October figures.

NNPCL still explain say di November output na di first recovery afta three straight months of decline wey start from August reach October.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app