By Ebi Oboko
Venezuela Presido, Maduro, 63, don go tell one US court for New York say dem kidnap am comot Venezuela, and say e no guilty, as e still dey claim say e be president.
Im wife, Cilia Flores, too talk say she no do anything bad, as both of dem appear for court.
US commandos carry dem early Saturday, and later President Donald Trump announce say America don take over Venezuela to fix and control di oil business.
Plenty country dey vex ontop dis mata, UN boss talk say make dem respect country boundary, while Mexico president say America continent no belong to anybody.