By Ebi Oboko
Saudi Arabia-led coalition day never break, early mor mor confamate say, dem don fire bomb scarra Dhale, Yemen, on Wednesday.
Say Southern Transitional Council (STC) leader Aidarous al-Zubaidi even jump comot plane wey im suppose use fly, use leg pick race for di mata, and dat up till now nobody know wia im enter.
Coalition add say e don gather plenty soldiers, tanks, gun, and munitions for Aden, then dem move go Dhale, so dem launch strike to stop di wahala for Yemen bordar.
Dem explain say the strike na preemptive move to protect Yemen government and prevent fight between STC and government forces.