By: Esther Ayoola
Lagos State Taskforce don arrest 32 street children wey dem dey call Omotaku, say dem dey cause wahala for area, dey block road across Island and Mainland, for areas like Apongbon, Fadeyi, Jibowu, Yaba, Lagos Island, Ojuelegba, and Surulere,
According to Taskforce tuk, tuk yarnings on Tuesday, Raheem Gbadeyan, dem catch di children because dem dey stop trucks, tankers, and private cars anyhow, dey smoke hard drugs, and dey disturb people.
Say, di operation hapun as part of di Taskforce clean-up exercise wey Chairmo, CSP Adetayo Akerele tuk, say dem dey do to make Lagos safe for everybody.