By: Esther Ayoola
Di Nigerian Meteorological Agency (NiMet) don yarn say from Wednesday reach Friday, plenty haze and sunshine go dey across Nigeria.
NiMet tuk dis on Tuesday for Abuja.
For north, sky go dey sunny and hazy every day, while for south, sky go dey sunny with small clouds.
NIMet also tuk say small chances of thunderstorm and light rain fit happen for Bayelsa, Rivers, Akwa Ibom, and Cross River later for di day.
Dem explain say dis kain weather dey happen because of seasonal changes and dust haze wey dey blow from di north, and people fit take am easy by dey ready for sun and rain.