By: Esther Ayoola
Lagos State Special Offences and Domestic Violence Court wey dey Ikeja don sentence 64-year-old former education director, Olawale Solomon Feleti, to 2 years 5 months jail.
EFCC tuk say, during COVID-19 wahala for 2020, Feleti use bank glitch take waka enter Access Bank credit card system.
According to EFCC, im withdraw at least N43,000 per transaction, kon convert total to N48.9 million comot wey im thief from di account.
Justice Rahman Oshodi find am guilty on five-count charge and kon convict am for stealing.