National

Wetin You Need Sabi About Bank Charge

todayJanuary 7, 2026 4

Background
share close

By: Esther Ayoola

Chairmo of di Chartered Institute of Taxation, Abuja District, Ben Enamudu, don clear  Nigerians say, nobodi dey tax anybodi bank balances under di new tax reform.

Untop yanings with news tuk tuk pipo on Tuesday, Enamudu, say only some electronic transfers dey attract ₦50 stamp duty.

Im say, na wrong tori wey dey spread dey make people fear unnecessarily, say bank go collect tax from account balance.

Di chairmo explain oh, dat  di reform dey designed to protect low-income earners, and no law dey, wey fit make gornment collect tax from money wey dey your bank account.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app