By: Esther Ayoola
Federal Gonment don share ogbonge update say dem wan turn Nigeria to global tech house and like dis, dem don officially launch di movement wey dem dey call Di National Agency for Science and Engineering Infrastructure (NASENI) Future makers initiative across obodo Naija.
Executive Vice Chairmo and CEO of National Agency for Science and Engineering Infrastructure, Khalil Suleiman Halilu, unveil di programme during event wey hold for Nigeria.
Im tuk say di initiative dey designed to find and empower young innovators wey dey between five and 16 years old.