Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
Say nor be small badness sup for Badagry, dat De Akran of Badagry Kingdom, Oba De Wheno Menu-Toyi, don die for age 89 afta short sickness on Monday.
Di respected king wey rule Badagry for almost 49 years na strong voice for Lagos State Council of Obas and Chiefs.
Untop yanings with tori pipo, Lagos govo, Babajide Sanwo-Olu, tuk say im death na big loss to Badagry people, Lagos State and Nigeria because of di beta impact wey im make.
Sanwo olu say Di late monarch na ruler wey sabi wisdom, protect culture and push development, as e leave behind legacy of unity and progress.
Written by: News Author
Akran of Badagry Akran of Badagry death Badagry monarch dies Oba De Wheno Menu-Toyi
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025