By: Esther Ayoola
Nor be small thing oh, eehooo, say Bandits don kpai kpai pipo for Benue again oh, say five pipo kpai for Otobi community, Otukpo LGA, Benue State.
One of di people wey dem say die, na 2019 PDP House of Assembly candidate, Igbabe Ochi.
According to report, di attack happen around 1:30am on Tuesday, after community volunteer guards do better commando scarra some jaguda boys wey wan bin do kidnapping for Ekwu-Ora’Odaba on Sunday night.
Locals tuk say, suspected herdsmen don dey reason di community since, afta dem kill 13 people for April 2025 and 3 more for May 2025.
As at di time konfam package dis report, Benue state police command never confamate wetin really play for di area.