National

Bandits Kpai 5 For Otobi, Benue State

todayJanuary 13, 2026 5 1

Background
share close

By: Esther Ayoola

Nor be small thing oh, eehooo, say Bandits don kpai kpai pipo for Benue again oh, say  five pipo kpai for Otobi community, Otukpo LGA, Benue State.

One of di people wey dem say die, na 2019 PDP House of Assembly candidate, Igbabe Ochi.

According to report, di attack happen around 1:30am on Tuesday, after community volunteer guards do better commando scarra some jaguda boys wey wan bin do kidnapping for Ekwu-Ora’Odaba on Sunday night.

Locals tuk say, suspected herdsmen don dey reason di community since, afta dem  kill 13 people for April 2025 and 3 more for May 2025.

As at di time konfam package dis report, Benue state police command never confamate wetin really play for di area.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app