By: Esther Ayoola
Oyo State Govo, Seyi Makinde, once again don clear im state member, say make dem dey alert and security-conscious.
Govo Makinde yarn dis on Monday wen e dey address public and civil servants during interfaith service wey dem hold for Ibadan to usher in di New Year.
E press tuk say, im gorment go always do wetin e suppose do to protect lives and property.