Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
Osun Police don start investigation into di killing of former NURTW unit chairman, Kazeem Oyewole, wey suspected hoodlums allegedly Kpai for Osogbo on Sunday.
Di murder cause gbege for some motor parks as people wey sabi Oyewole dey waka around dey find those wey dem think kill am.
Oyewole, wey be part-time chairman of NURTW Aregbe Unit from 2018 to 2022, get attack around Elelede Junction for afternoon, but di full story no clear as at press time.
One resident wey see wetin hapun from far yan say some Jaguda boys na do rubbish for Elelede Junction, however, say police don dey touchlight di mata.
Written by: News Author
Ex-NURTW Boss Killing NURTW Crisis Police Manhunt Osun
todayJanuary 19, 2026 3 4
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025