By: Esther Ayoola
Say, nor be small gobe for area, at least two pipo say ni kpai on Sunday for Lagos-Ibadan Expressway, Kara Bridge side, near Mowe, afta some motors jam demsleves.
According to di Lagos state Traffic management agency tuk tuk, Adebayo Taofiq, say di accident happen when one truck wey dey carry bags of flour lose control, ram several commercial buses and one parked Toyota Corolla, wey wunjor di driver yangayanga.
Di agencies say dem rush enter di scene like bruce lee to rescue di wunjored pipo and manage traffic.
Dem dey sama drivers warning toalways dey careful as investigation dey go on to find out how di crash happen.