By: Esther Ayoola
Wi oga Presido, Bola Tinubu don order full investigation into di killing of housewife Fatima Abubakar and her six pikin for Chiranci community, Kano State, on Monday.
Im Special Adviser on Information and Strategy, Bayo Onanuga, tuk say di President belle nor sweet am at all for di mata, call am barbaric.
Tinubu Sha praise police for di quick arrest of di main suspects.
Him don direct all security agencies make dem prosecute di case, to bring justice.