By: Esther Ayoola
Oga Govo, Babajide Sanwo-Olu of Lagos State don send accusation to local and foreign Non Gorment Organizations say, dem dey use di Makoko demolition mata take cash out and dat evidence full ground.
Im put dis one for tori tuks with news waka waka dem, say, di state carry out di demolition for di safety of di people, because many houses dey under high-tension cable.
Sanwo olu say, im dey aware of all di wuruwuuru, wey dey go on and dat gornment nor go allow anybody take advantage of di situation while lives dey at risk.