By: Esther Ayoola
Lagos state gornment don konfamate say dem wan resume work for di 2 and 3 sessions of Lekki-Epe Expressway (from Ajah Bridge to Admiralty) on Sunday, January 25, 2026.
Special Adviser to di Lagos State Governor on Infrastructure, Olufemi Daramola, na dey conversate dis update to tori pipo say, di contractor don already arrange im tools for ground afta smalle delay for Christmas, new year period.
Say dis ogbonge project go last for 64-days and e go hellep reduce go slow for di express way.