By: Rilwan Agbomeji
Lagos State Govment don give squatters wey dey under Obalende bridge small small time make dem comot as dem wan beautify di place.
Untop yarnings with tori pipo yesterday, Commissioner for Environment, Tokunbo Wahab, talk say dem don dey tell dem since 2024, and enforcement officers dey ground to carry out di quick notice.
According to report Gornment wan hand over di space to company wey wan maintain am as part of CSR, with motor garage, public toilets, sleeping bays, and EV charging points.
Dem also tuk say dem go clear all hoodlums wey dey terrorise people for di area.