National

President Tinubu Give Go Ahead For Shell Bonga Oil Project

todayJanuary 23, 2026 6 1

Background
share close

By: Esther Ayoola

Oga Presido, Bola Ahmed Tinubu, don approve make dem gazette special incentives wey go support Bonga South West deep-offshore oil project wey Shell and im partners dey plan.

Oga Presido give di approval yesterday as im receive di kontri top mehn for di Oil sector for Aso Rock.

Nigeria National Petroleum Company Limited oga, GCEO, Bayo Ojulari, ni bin lead di Shell team, including their global Oga, Wael Sawan, meet di President for State House.

Tinubu say di incentives dey sharp, and e go fit compete anywhere for world.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app