By: Esther Ayoola
Naija Bible Society don put dia voice for di ban of indigenous language use for our schools, say make wi Federal Gornment rethink, dat e go kill our own cultural tongue.
Oga Bible society, CEO, Pastor Samuel Sanusi, na dey yarn dis one for tori tori sitting with aproko pipo for Lagos, say plenty Nigerian languages don dey die because of di move by wi federal gorment.
Im sha, beg federal gornment make dem continue to allow di languages for our primary and secondary schools, to save Naija culture.