Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
Electricity Power distribution companies, don pull shirt dey laugh wi federal gorment say, di tuk wey Minister of Power, Adebayo Adelabu, yarn dat prepaid meters na free for customer, say na yeye tuk.
Operators wey carry aproko wey nor mention name because of fear, tell tori pipo, oga minister just yarn for political reason and e no ask other pipo wey dey involved, like installers and meter providers.
U sabi say, On Thursday, Federal Gornment yarn say DisCos and installers no suppose collect any money for meters, and anybody wey dem catch dey collect money, go dance Osurugede dance.
Adelabu yarn dis one when im go check new smart meters wey land for APM Terminals, Apapa, Lagos.
Written by: News Author
Electricity Discos Nigeria FG power sector Free meter scheme
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025