By: Esther Ayoola
Di Police Service Commission (PSC) and Nigeria Police Force for Nigeria don extend dia recruitment programme of 50,000 police constables, say dem don add two weeks based on some states, including Lagos, dey record low application.
PSC Head of Protocol and Public Affairs, Torty Kalu, tuk dis one on Monday, say extension dey follow receipt of over 400,000 applications nationwide and uneven participation across states.
Di online application wey open on December 15, 2025, wey suppose close January 25, 2026, go now close February 8, 2026.
Dis recruitment dey part of government plan to boost security afta President Bola Tinubu declare nationwide security emergency and order more personnel to tackle rising insecurity.