By: Esther Ayoola
Say Some Pipo from Ilu-Abo community for Akure North Local Gornment Area for Ondo State scata ground yesterday, dey protest say, di way pipo take dey kpai, kpai and jaguda boys kidnaping dia pipo don tire dem.
According to report, Dem block Akure-Owo-Benin highway to make gornment hear wetin dey happen and say security nor dey shake bodi for di mata.
One protester, wey name na Lawrence, say, di fear for di community nor be small, because of di way dis jaguda boys take dey attack dem for almost three years, and recent one na di abduction of one person plus attack on three others, including woman.
Say di mata don tire dem, as dem ma dey call on gorment to come hellep di community.