By: Esther Ayoola
Two big traditional rulers for Oyo State, Soun of Ogbomoso, Oba Olaoye Ghandi and Alaafin of Oyo Oba Akeem Owoade, ni comot bodi for Governor Seyi Makinde celebration of Oyo state at 50 on Monday.
Plenty important pipo like family members of former govos, traditional and religious leaders, gornment oga dem and political big men gather for International Conference Centre, Ibadan, to mark di celebration.
Oyo State wey dem create on February 3, 1976 from old Western Region, get Ibadan as im capital.
According to report, State gornment don plan one-week programme wey go include church and mosque service, cultural display, award and dinner night, plus public lecture.