By: Esther Ayoola
Lagos State Gornment don repeat tuk, say dem go still upgrade Makoko community for Lagos Mainland, and dat, dem nor get plan to scatter pipo community.
Say, Dem don put $2 million as dia own share for di project, and dem dey wait for another $8 million from United Nations to start work.
Special Adviser to Governor on eGIS and Urban Renewal, Dr Babatunde Olajide, ni dey convasate dis one inside  special press conference for Alausa, ikeja,  say di recent demolitions na only because of some houses wey dey under high-tension electric wires and e dat e dey unsafe.