Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
Di Lagos state gorment one week war against Measles-Rubella (MR) and Routine Immunisation (RI) Campaign don dey finally end officially 5 February, 2026.
Na January 27, 2026, wey First Lady of Lagos State, Dr. Ibijoke Sanwo-Olu flag off di campaign sending her disciples to various primary health centres across di state for di different local gorment area.
According to report dis campaign sef dey measure shoulder with di ogbonge national and global immunisation goals, wey sabi pipo arrange to protect children and adolescents from vaccine-preventable diseases.
A week don go now, di next questions na what next, dis Konfam news carry waka go primary healthcare centre for Ikosi Isheri, di Health Education and Health Promotion Officer for ikosi Isheri, Balogun Morenikeji Mautin, clear Konfam News matas on mission wey dem buy waka for Lagos.
Di Health Educator say dem carry di mata reach grassroot untop based on di importance of the Vaccination.
Speaking on di Level of join bodi doings by di community pipo, Oga kpatakpata di Medical Officer Health of Ikosi Isheri, Dr Okunade Adebayo Oyeniyi, say di compliance pass 100% as dem plan to open vaccination centre across all primary health centre even afta di one-week campaign period.
Written by: News Author
Lagos rubella control Lagos statewide immunization Measles vaccination Lagos
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025