By: Esther Ayoola
Lagos State Assembly don meet Makoko people wey demolition affect on Monday for Lagos, to address di wahala wey di demolitions dey cause.
Chairmo of House Committee on Makoko Demolition, Majority Leader, Noheem Adams direct say, make all ministries and agencies stop demolition for Makoko, Oko-Afon, and Shogunro, to prevent more community stress.
Adams say, moving forward, lawmakers go waka go di area to check wetin dey happen on ground and confirm di specific setbacks for gornment before dem go take decision.
Say Community leaders go join Taskforce Committee wey dem go form so dem fit participate and find solution for di problem.