By: Esther Ayoola
81 Division of di Nigerian Army don begin touch light doings for Apapa, after chairmo of Apapa-Iganmu LCDA, Jimoh Saliu, accuse some military officers, dat, na dem dey give drug dealers leg for di area to misbehave.
Untop aproko to tori pipo, Saliu say, based on di anyhow doings, one area wey dem dey call Gidan Drama, for Marine Beach, near Tego Army Barracks, don turn hide out for illegal drug business.
Im say, di place dey full of notorious criminals wey dey do plenty bad tins like selling drugs and stolen goods.
And like dis Army don promise to checkmate di mata, and dat any criminal wey dem catch go face di law.