National

Amotekun Officer Testify Say E Knack Bullet With Owo Church Attackers

todayFebruary 11, 2026 3

Background
share close

By: Esther Ayoola

One Amotekun officer wey dem dey call SSG don testify for Federal High Court for Abuja say e fight gun battle with one of di pipo wey attack St. Francis Catholic Church for Owo on June 5, 2022.

E say afta dem hear wetin hapun, dem rush enter bush based on information from eyewitnesses and meet di attackers as dem dey run.

SSG tuk say when e reach di church, e see plenty dead bodies for ground, including women and children, and many pipo wey get serious wunjury.

Say Dem carry di injured go Federal Medical Centre for Owo, while dem move di dead bodies go St. Louis Hospital.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app