By: Rilwan Agbomeji
Federal Road Safety Corps for Plateau State don drop strong warning to Valentine pipo, say make dem no try drink and drive or do any kain dangerous behaviour for road during celebration.
State Sector Commander, Adelaja Ogungbemi, tuk dis one for statement wey Public Education Officer, Peter Longsan, sign on Saturday.
According to am, di warning follow directive from di Corps Marshal to make sure say maximum safety dey for road and no life go loss during di festivity.
Ogungbemi come clear am well say FRSC no go gree for drunk-driving, overspeeding and reckless driving, and anybody wey break di rule go face sanction sharp-sharp.