By: Esther Ayoola
Naija Centre for Disease Control (NCDC) don konfamate say 70 people ni don kpai from Lassa fever for di first seven weeks of 2026, with 318 konfam cases from 1,469 pipo wey dem suspect get di disease.
Say di disease sti dey mostly for five states wey get 91% of di cases, and 10 local government areas dey carry 68% of di infections. NCDC tuk say Lassa fever na normal thing for Naija and e  dey sabi increase for dry season from November reach May, and say quick diagnosis and treatment fit save life.
Dat Gornment don send rapid response teams and supply laboratory kits, medicine, PPE, and other infection prevention materials to hellep fight dis outbreak for di eight affected states, including Bauchi, Ondo, Taraba, Edo, Plateau, Benue, and Jigawa.