By: Esther Ayoola
Lagos State House of Assembly don komfam say dem no go allow any more demolitions for Makoko and Shogunle.
On Thursday, during committee meeting with community leaders, Speaker Mudashiru Obasa, through Majority Leader Noheem Adams, fry mouth wetin on wetin dem wan do now, say each community go form 10-person committee to work with gornment.
Di Lawmakers say dem go finish settlement with di communities within two weeks to make sure say, peace return.
Dem also approve new rule wey ban any building within 250-metre from Third Mainland Bridge plus 250-metre from power line corridor to protect residents and prevent badness.