By: Esther Ayoola
Opposition political parties don reject di 2026 Electoral Act wey President Bola Tinubu sign into law, say some parts of di law fit spoil free and fair election for 2027.
For press briefing wey dem hold for Abuja on Thursday, leaders like Atiku Abubakar, Peter Obi and Rotimi Amaechi say National Assembly must remove wetin dem call “obnoxious provisions,” especially di clause wey allow manual transmission of results if network fail.
Dem argue say Naija get enough technology to do full electronic transmission and warn say manual option fit open door for manipulation and dat na no, no, no
But Senate no waste time respond, dem tell Atiku Abubakar, Peter Obi and Rotimi Amaechi make dem carry dia complaints go through proper National Assembly process and not to come press, dey yarn okpata.