Di Department of State Services, DSS don arrest one man, Udeme Monday Stephen, wey dem dey suspect say e plan di attack wey hapun for Benin City, Edo State, against 2023 presidential candidate of Labour Party, Peter Obi, on February 24.
U sabi say, Jaguda boys attack Obi and some ADC chiefs wey bin dey do meeting to welcome former governorship candidate Olumide Akpata join dia party.
According to report, Stephen allegedly post threat for im X account @stevetom788, say e fit attack Obi again, na why DSS carry am arrest.
Peter Obi, wey be former LP presidential candidate, even tuk for Benin City say dem go make formal complaint before dis arrest.