OBODO NAIJA

Dangote Raise Petrol Price, Pump Fit Hit N1,000 Per Litre

todayMarch 3, 2026 3

Background
share close

Dangote Petroleum Refinery don raise dia factory price of petrol from N774 to N874 per litre.

National Publicity Secretary of di Independent Petroleum Marketers Association of Nigeria, Chinedu Ukadike, na im share dis update on Monday.

Based on dis, Say petrol fit cost between N980 and over N1,000 per litre for motorists depending on wia dem dey across Nigeria.

Ukadike explain say di increase na because of di wahala for global crude oil prices, say na im dey affect local supply and logistics.

Di refinery official also confirm say di new price dey effective immediately as part of measures to cope with international market wahala.

Written by: Ridwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app