By: Esther Ayoola
For Surulere, Lagos, say some suspected land grabbers wey pipo sabi as Omo Onile don demolish about 50 houses, making pipo homeless.
Dat di jaguda boys just waka enter di community on Tuesday, 27 January 2026, dey demand between N15 million and N25 million from house owners.
Say Pipo wey no fit pay, na dia houses dem don demolish.
Founder and Chief Executive Officer of Oikus, Israel Ihaza, ni dey konfamate dis tori on Sunday, and as at di time wey wi package dis report, state authority never sti put mouth for di mata.