Ondo state govo, Governor Lucky Aiyedatiwa don sama warning say any pesin wey dey sponsor terrorism or kidnapping wey dem go catch go face prosecution.
Im tuk dis one wen e meet leaders of Miyetti Allah Cattle Breeders Association of Nigeria (MACBAN) for im office for Akure, Ondo State.
Aiyedatiwa still say e dey worry am say one community don get three kidnapping cases for just two months, and dats why dem dey move agbag di jaguda boys.