Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Ride-hailing drivers for Lagos, under Di Union of App-Based Transporters of Nigeria, AUATON, Lagos chapter, say dem go do three-day strike from March 16 to 18.
Public Relations Officer, Steven Iwindoye, explain dat, while fares for Uber, Bolt, InDrive, and Lagride never change, cost of living wan kill di living.
For di period of di strike, drivers go log off dia apps, and passengers go find am hard to book rides for Lagos.
According to di Union, dem dey take dis action after long complaints about harsh economic condition wey dey affect drivers’ financial survival.
Written by: Ridwan Agbomeji
Bolt inDrive Lagride Drivers Uber
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026