By: Esther Ayoola
Lagos State Emergency Management Agency don share update say, na 173 emergency mata na im don handle between January and February 2026.
Permanent secretary, Dr Olufemi Damilola tuk dis one for statement on Sunday as im ma dey share detail of dia operations.
Road traffic wahala, ni be di worse according to di permanent secretary, with 56 cases, 53 na normal crash, 3 na bus or car wey catch fire.
Trucks and tanker palava sef reach 35 cases, wey include 27 crashes, 4 breakdowns, 2 fire, and 2 fallen container.