National

FG Arrange Plan To Evacuate Nigerians From Middle East

todayMarch 17, 2026 4

Background
share close

By: Esther Ayoola

Federal gornment say, dem dey arrange how to evacuate Nigerians wey dey trapped for some Middle East countries because of di ongoing crisis.

Nor be amebo say di tension for di region rise afta United States and Israel carry out military strike against Iran on February 28.

Tuk, tuk of di Ministry of Foreign Affairs, Kimiebi Ebienfa, say gornment dey work on administrative arrangements and release of money to start di evacuation.

Dis update dey come afta Many Nigerians for countries like United Arab Emirates, Kuwait and Qatar bin send worry of how di crisis don disrupt flights and travel plans.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app