By: Esther Ayoola
Vice Presido Kashim Shettima don tuk say Federal Government go make sure say dem defeat terrorism, and anybody wey dey behind recent attacks go face serious action.
E tuk say apart from order wey president don give security chiefs, government dey put more money for equipment and logistics to strengthen di fight against terrorism.
Shettima yarn dis one for Maiduguri when e go visit people wey bomb blast injure for University of Maiduguri Teaching Hospital where dem dey receive treatment.