Lagos State Emergency Management Agency don konfamate say one person don die for gas tanker and tipper truck explosion wey happen for Lekki-Epe Expressway on Saturday.
Dis update come after Margaret Adeseye wey be Controller General of Lagos State Fire and Rescue Service tok say property worth thousands of naira don spoil, while two people burn beyond recognition for di askident.
For statement, Permanent Secretary of LASEMA, Olufemi Oke-Osanyintolu, say one life lost and two others get injury for di incident wey happen for Ologuro Bus Stop, Sango-Tedo.
E explain say when dem Shark Team reach di scene, dem see say one tipper truck wey no get clear plate number don jam gas tanker from back, wey cause fire outbreak.
Preliminary investigation show say na overspeeding and reckless driving by di tipper driver cause di askident.