14 Brigade Nigerian Army don tell farmers and people wey dey near 14 Brigade Range Area make dem no fear if dem hear gun shots from Monday, March 23 go reach Wednesday, March 25, 2026.
Di Brigade talk say dem go do first Range Classification exercise to improve how soldiers dey handle weapons, shooting skills, and marksmanship.
According to statement wey Captain Mazinho Attah sign, di exercise go happen for 14 Brigade Shooting Range, Goodluck Ebele Jonathan Barracks, Ohafia, Abia State.
Dem advise say farmers and residents wey dey near di area make dem waka comot from di shooting range during di exercise days.
Written by: Rilwan Agbomeji
14 brigade nigrian army NIGERIAN ARMY