Sports

Man City Beat Arsenal 2-0 To Carry League Cup

todayMarch 23, 2026 4

Background
share close

Manchester City don win dia first trophy for dis English season as Nico O’Reilly score two goals for di second half to hellep dem beat Arsenal 2-0 for di League Cup final.

Arsenal wey be Premier League leaders come as favourites, but power pass favourite for Wembley stadium.

Di first half no too get action, but O’Reilly first goal come after Arsenal goalkeeper Kepa Arrizabalaga fumble.

Four minutes later, O’Reilly score again from Matheus Nunes cross, settle di matter as Arsenal try but no fit find di net.

Written by: Ridwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app